Naija don collect only 1 point from de 2 games wey dem don play for ness year Nations cup kwalifia, and Oga Amaju yarn say na to waya Sudan for dia house na hin go helep de Supa Eagus.
De NFF presido dey ground watch de Supa Eagus training for Abuja, and de man tok say de NFF go tanda for de back of de Supa Eagus.
“De lass NFF board don try for Naija, and we masef wan carry on from dia lass bus stop.
“Dis na de reason why I tok say de Sudan game na muss win for Naija becos dis na de fess game for our own board,”. Naso Oga Amaju yarn
As Oga Amaju kon tok finish, naso Supa Eagus numba 1 golkipa, Vincent Enyeama yarn say im and hin teammates no go fall Naija hand for de match.
“Mr presido, no shaking, and we wan also salute unna on de election wey carry you enta de NFF, and we wan promise Naija fans say wit God, everything dey kampe,”.
0 comments:
Post a Comment